Adblada

Sunday, 31 January 2016

LONDON BRIDGE IS FALLING DOWN: TATAFO YOU DON HEAR?



London Bridge is falling down? Wait a moment, I saw this lovely piece from Stella Stella Dimokokorkusenjoy it: “Who composed the nursery rhyme.. " London bridge is falling down" sef?


I beg how una side?

See ehn, I like minding my business but people won't let me be. Any small thing, "tatafo come and hear o". "Tatafo you don hear?". "Tatafo London bridge is collapsing oooooh"...... 

OK..so today, make I yan una wetin one London boy dey take women eye see for this London. This guy ehn, his last name on Facebook is the same as that popular sexy Latino/American musician with big booty! 

She's so sexy that P Diddy wan die put before dem scatter. 


Ehn ehn..so this London boy now, very jobless and always on social media. I  hear say the boy join British army one time. After that, he worked as a London bus driver before he begin do fast fast things for a living. As per laziness no gree am stay one job.

Wetin be him gist?....

Well, for this London alone he get like 3 baby mamas..bet why? This boy is so notorious that his lies can really collapse London bridge true true and Plenty 'innit' babes have entered one chance because of his sweet mouth. 

He's tall, dark and very chubby...some people call him 'pot bellied' sef.  He likes claiming single and promises all his girlfriends marriage. 

Fiam, not too long ago, he went to naija to marry one yoruba actress  That very dark skinned babe with a "wickid" hour glass shape in yoruba nollywood who rarely appears in other people's movie production other than her own.

About 2years ago, Na so London girls begin protest when they heard that Mr G had gone to Nigeria to marry madame actress. Wetin dey vex dem be say he no dey take care of hin pikin dem for London. In fact .. dem say he dey owe some of him babes money but still had the nerve to go do a loud wedding in Nigeria..Forming "London big boy".  That's how one of his victims saw tatafo in Tesco store begin lament o. The young pretty lady talk sotey tatafo begin pity her.  

She narrated how she gave Mr G all her life savings in London including her student loan, because he had lied to her that he wanted to use it to for a business that would be of mutual benefit to both. 

Boom, na so she enter one chance ooooh

 Na so her friends to call her that her man was in Nigeria getting married to this nollywood girl who sometime ago was romantically linked to a very controversial SW governor in Nigeria.


 Dem say she get store dey sell paraga sef. She had a boy for Mr G not too long ago. Present at her wedding were her colleagues, some of these colleagues wey don even follow chop Mr G cookie but that one no concern tatafo and e no concern you wey dey read this one.

Wetin concern tatafo  be say, now, it looks as if things are not so rosy for this couple again. As Mr G used to gush a lot about his nollywood actress wife on social media but that has since stopped. 

Tatafo gathered that she thought Mr G was loaded with pounds, but later realised say shishi no gum am. 

The koko of the matter now is that Mr G has been hunting for new babes on social media again and tatafo has proof, because one girl don send tatafo their munched chat... if una see how this guy dey beg this babe ehn...say he wan marry her, he loves her, he's crazy about her etc. 


I beg, wetin happen to him new wife? What about the 3 baby mamas in London who are suffering to take care of the children he abandoned? He's back living in London, while his wife is in Nigeria. 

Hmmmmmmm,Na geographical bachelor him be..so don't be fooled!!

Tatafo dey warn London girls now o. Make una no say tatafo no tell una. Mr G is on the loose again to catch a prey. He go collect una small change ,promise una marriage,dash una STD and belle join sef and it won't be breaking news. 

Mr G na memo i dey send you so ooooh, please stop looking for a new prey and face your marriage and try to fix whatever problems oh otherwise tatafo go open your yansh with those new marriage proposal chat sharp sharp!  

Tatafo don talk finish...

Till next time....

Yours truly. 

Tatafo


No comments: